Kontris wey don qualify for Wafcon 2026 quarterfinals

Wia dis foto come from, Getty Images
Di Women's Africa Cup of Nations competition don dey enta business zone as kontris don dey qualify for di quarterfinals.
16 kontris dey fight for one trophy for di 35-year-old competition.
Four more kontris bin add to di initial 12 for dis expanded edition wey dey happun for Morocco.
Some teams bin play three group games - odas don play two.
Out of di four groups – three teams don already qualify for di quarterfinals.
- Morocco qualify afta dramatic Senegal draw
Di host kontri bin qualify for di quarterfinal afta dem get seven points from three games for group A.
Di Atlas Lionesses draw 0-0 wit Senegal; inside one game wey bin get plenty drama.
Morocco dominate di game but dem no fit score - Senegal goalkeeper Adji Ndiaye save two penalties togeda wit oda ogbonge saves to deny di hosts.
Morocco sama Kenya 4-0 for first game bifor dem snatch late 1-0 win against Algeria and play scoreless draw wit spirited Teranga Lionesses.
- Algeria qualify afta soft work vs Kenya
Algeria finish second for group A wit six points afta dem scata Kenya 2-0.
Dia captain Marine Dafeur bin score one long-range freekick for di first half to set di tone.
Dem score di second goal nine minutes later afta some defensive mistake by Kenya.
Di result mean say Kenya don comot di competition wit zero points from di three group games, wia Algeria join Morocco to qualify for di quarterfinal.
Cameroon reach di quarterfinal afta dem win dia first two games
- Cameroon bin qualify for di next round even bifor dem go play dia last game for group D.
Di Indomitable Lionesses sama Ghana 1-0 wit one penalty for di second game for dia group afta dem beat Mali 2-1 for di group opener.
Wit di result, dem don secure dia place for di quarterfinal ahead of dia final game wit Cape Verde on Thursday 6 August.
Either Ghana or Mali fit join dem for di quarterfinal if dem win or draw as dem dey face each oda.
Both Ghana and Mali get three points - di Black Queens go get six points or four points wey go make dem progress; same tin wit Mali if dem win or draw, dem go join Cameroon for di next stage.
- Group C go still wait afta Match Day 3 to find di teams wey go qualify
Dis group bin get defending champions - di Super Falcons of Nigeria, wey get record 10 Wafcon titles.
Currently, Malawi dey lead di group wit six points from two games - dem beat Egypt 3-1 and sama Nigeria 3-2.
Di Super Falcons get three points afta dem secure hard-fought 1-0 win against Zambia, to bounce back from di group opener wen dem lose 3-2 to debutants Malawi.
Di Copper Lionesses of Zambia get three points also - dem thrash Egypt 6-0 for di group opener; Babara Banda bin score four goals for dat game.
Na only Egypt get zero points for dat group.

Wia dis foto come from, Getty Images
Nigeria gatz win or draw wit Egypt to qualify for di next stage; Zambia need at least a draw
Egypt don comot afta dia two defeats but dem wan play for pride for dat final game against Nigeria.
Dis be di third time Egypt don comot di Wafcon for di group stage.
Malawi and Zambia go jam on Wednesday for 8PM GMT, di same time Nigeria go face Egypt.
We go find out di five oda teams wey go join Cameroon, Morocco and Algeria.
Winners for di competition go get $2m prize money, an increase from di $1m wey di last winners bin get.
Di second team go get $500k, di third go get $350k while di fourth team go get $300k.










