Donald Trump say e dey ban CNN, MS NOW and Politico from White House

Wia dis foto come from, Jim WATSON / AFP via Getty Images
US President Donald Trump don announce say e dey "immediately" ban CNN, MS NOW and Politico from di White House.
Dis na di latest twist for im cat and rat relationship wit American media.
For one lengthy post on Truth Social on Friday, Trump say di outlets dey "constantly write or report fiction or lies" about im administration, although e no provide examples.
E dey unclear wetin exactly di ban go be, and weda employees of dose outlets go dey prevented from entering di White House grounds.
Di move dey likely to receive legal challenges from di outlets wey dey involved and press freedom organisations.
Reporters from both Politico and CNN bin still dey for White House grounds shortly afta e make di announcement.
"Media outlets no suppose to constantly write or report fiction and lies wen dem dey cova di President of di United States, di trump administration or di United States of America," Trump write. "Oda news outlets to follow."
Di post no mention specific stories or reporting wey lead to di move.
Wen dem ask am about di ban for di Oval Office, Trump say "reason no dey" for di ban wey e announce for Friday afternoon.
"Na really just cumulative stories ova di last few years," e tok. "You get sick of am."
Trump say 'odas fit join dem', but e no name any specific news outlet.
Since e return to office for January 2025, Trump and administration officials don repeatedly clash wit members of di White House press corps.
For February of dat year, di White House bin announce say dem dey take back control of di press pool wey get access to Trump and wey di White House Correspondent's Association bin don manage for more dan 100 years.
Di same month, di administration bin move to bar Associated Press (AP) reporters and photographers from spaces wia access dey limited, such as di Oval Office or Air Force One, becos of di outlet usage of di term "Gulf of Mexico" instead of "Gulf of America".
Di Associated Press swiftly file one lawsuit and di case still dey go on.
Di president dey often clash wit reporters for di Oval Office and on Air Force One, as e dey always refer to dem as "fake news" and "rude".
For im first term, Trump also ban CNN correspondent Jim Acosta from di White House, although dem restore im credentials afta CNN sue.
For one statement on Friday afternoon, di Knight First Amendment Institute for Columbia University say "wit so many courts wey rule against am on exactly dis point, you go tink President Trump go don learn dis lesson by now".
"If President Trump mean to expel dis news organizations from di White House press pool, im action dey doubly unconstitutional becos di press pool na 'public forum' under di First Amendment, wey mean say di president no fit exclude journalists from am on di basis of dia viewpoints," di institute executive director, Jameel Jaffer, tok.
One leading law group wey dey provide legal services to di media - di Reporters Committee for Freedom of di Press - say dem expects Trump ban to dey quickly struck down by di courts becos e dey "flatly unconstitutional".









