South Africa President Cyril Ramaphosa comot hand from public engagements as e fall sick

Wia dis foto come from, Alexander KAZAKOV / POOL / AFP via Getty Images
South Africa President Cyril Ramaphosa don withdraw from official duties, sake of health issue, di Presidency announce.
Di presidency for one post on dia official X account on Wednesday tok say di president media team advise am to rest and recova, afta e return from di Brics Summit for India on Monday.
Di President don ask respective ministers to represent am for scheduled public engagements, wia possible.
Although, di presidency no disclose di nature of di president sickness, e however dey come one day afta di Deputy President Paul Mashatile announce say im dey recover afta one minor medical procedure.
Oga Mashatile wey don dey sick for some time, tok say neva dey clear wen im go resume official duties.
"Fellow South Africans, as many of you know, I recently carry out one minor medical procedure. I dey pleased to share say my recovery dey progress well, and I dey regain strength each day.
On di advice of my doctors, I go continue to rest until my doctors advice me otherwise," di deputy president tok.
E also say im don delegate responsibilities to im team, plus oda stakeholders for govment, business and oda sectors.
Dis one mean say di kontri two top leaders dey absence from public duties.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post






