Lagos mourn as dem lay former deputy govnor and Nigerian senator Idiat Adebule to rest

Wia dis foto come from, Senator Idiat Oluranti/X
Dem don lay Nigerian Senator wey represent Lagos West Senatorial District for di 10th National Assembly, Idiat Adebule to rest for Lagos, southwest Nigeria.
Senior pipo for govment wey include Nigeria Senate President Godswill Akpabio, Lagos state govnor Babajide Sanwo-Olu, Chief of staff to President Tinubu Femi Gbajabiamila, former Lagos govnor Akinwunmi Ambode wey she bin serve as im deputy, plus oda APC stalwarts attend di burial to pay dia last respect.
Oda pipo wey attend include members of her constituency, plus supporters of di All Progressives Congress (APC) show for her burial to pay her last respect.
Dem lay her to rest on Sunday, 29 November for one private cemetery for Lagos.
Di death of di ogbonge politician on Saturday, 28 November bin come as rude shock to di APC and Nigeria as a whole.
Following her death, di Lagos state APC don suspend all campaign activities across di state as political leaders, former colleagues and party members continue to mourn di death of di former Lagos deputy govnor.
Di Director-General of Lagos State APC PBAT/KOH Campaign Council, Senator Musiliu Obanikoro, also direct say make all campaign activities stop until further notice.
According to di party, dem take di decision sake of of di grief wey don surround di party following her death, and to give di late senator di honour and respect wey she deserve becos of her contributions to public service and Lagos state development.
Di party direct all campaign structures, committees, directorates, supporters and stakeholders to obey di directive.
Di Lagos APC also announce say dem don postpone di Lagos West Senatorial District campaign rally wey suppose hold on Monday, 30 November for Police College, Ikeja.
Her death don attract tributes from President Bola Tinubu, Senate President Godswill Akpabio, Lagos state govnor Babajide Sanwo-Olu, former Lagos state govnor Akinwunmi Ambode wey Adebule bin govern di state, di All Progressives Congress party, plus oda political leaders across boards.
President Tinubu bin express shock and sadness ova her death. E describe her passing as a painful loss to Lagos State, di National Assembly and dikontri, as e recall her contributions to governance, education and public administration.
Senate President Godswill Akpabio describe Adebule as a treasured colleague and accomplished administrator for im condolence message.
Di All Progressives Congress for statement to announce senator Adebule death tok say,"apart from say she be dedicated public servant, she be accomplished educator, and steadfast progressive whose contributions to di growth of our great Party and di development of Lagos State and our dear nation remain indelible."
Di party say her passing na ogbonge loss not only to her immediate family, but also to di entire progressive family across kontri.
She go dey fondly remembered for her loyalty to di ideals of di APC, her bridge-building disposition, and her selfless service to humanity.
Who be Idiat Adebule
Senator Idiat Oluranti Adebule na Nigerian educationist, writer, administrator, and politician.
She dey represent Lagos West Senatorial District for di Nigerian Senate.
She be member of di All Progressives Congress (APC) and she dey known for her previous position as Deputy Govnor of Lagos State.
Adebule begin her educational journey at Awori College, Ojo, Lagos State and she later proceed go Lagos State University (LASU), wia she obtain Bachelor of Arts for Education in Islamic Studies in 1992.
She earn master degree in Curriculum Studies in 1997 and a Doctor of Philosophy (PhD) in Curriculum Studies in 2012 for di same school.
Afta she complete her National Youth Service Corps (NYSC) programme for Bauchi State, she start to dey work as lecturer at di Lagos State College of Primary Education, Noforija, Epe, in 1995.
Adebule begin public service job for 2000 wen dem appoint her Commissioner I for Lagos State Post-Primary Teaching Service Commission (PP-TESCOM),
She later serve as member of di Lagos State Scholarship Board between February and November 2005, wia she dey involved in scholarship administration.
For July 2011, Govnor Babatunde Raji Fashola appoint her Secretary to di Lagos State Government (SSG). She become one of di key administrative officials for di state govment.
Her major political move come for 2015 wen she dey selected as di running mate to Akinwunmi Ambode, di All Progressives Congress govnorship candidate for Lagos State.
Dem win, and dem swear her in as Deputy Govnor of Lagos State on May 29, 2015. She serve for di position until May 29, 2019, afta she di sixth woman to occupy di office.
Afta she complete her tenure as deputy govnor, Adebule remain active for Lagos State politics and APC.
For 2023 general election, she contest for di Lagos West Senatorial seat and defeat her opponents to emerge as senator-elect.
She is di APC Lagos West Senatorial District candidate.




















