Bank of Ghana confam cyber attacks on banks and outline steps dem dey take to address am

Wia dis foto come from, Getty Images
Bank of Ghana (BoG) don announce temporary measures to protect di kontri financial system and customers funds afta one recent cyber attacks and disruptions, wey affect some banking apps and digital payment services for di kontri.
Di kontri apex bank for statement on Sunday, 29 November, confam say wetin happun to di banks na cyber attacks and e target various sectors of di economy.
"Di Bank wish to inform di public of recent cyber attacks wey target various sectors of di economy, including institutions within di financial eco system, plus tori of disruptions to some banking and digital payment services".
BoG for statement confam say dem dey work wit di "Cyber Security Authority (CSA), banks, specialised deposit-taking institutions, payment service providers and di Ghana Interbank Payment and Settlement Systems Limited (GhIPSS) to assess di situation, contain di incidents, restore services, and safeguard di integrity and stability of di financial system."
Protecting customers' funds remain our utmost priority, plus di financial system remains sound, BoG add.
Na on Friday, 27 November, some bank customers realise say dem no fit carry do online transaction or carry out digital services on dia banking app, and dis don lead to widespread frustration for di kontri.
Di apex bank assure kontri pipo say as at di time dem issue di statement, nothing dey to show say anytin don tamper wit customers deposits.
Dem say financial institutions dey actively monitor transactions and dey strengthen protective controls as investigations continue.
Meanwhile, di Bank of Ghana don release precautionary measures to ease di situation.
Precautionary measures BoG take to address attack

Wia dis foto come from, Ernest Ankomah/Bloomberg via Getty Images
Part of measures wey di central bank take wit immediate effect, include:
- Extended banking hours: Banks go extend hours to serve customers wey need transactions above di revised limits. Di central bank say make affected customers visit dia nearest branch for assisted service afta verification.
- Agent transaction limits: Daily and monthly limits now apply to mobile money agents.
- Reduced transaction limits: Dem don temporarily reduce daily limits on mobile money wallets and bank accounts.
- Alternative channels: Where app, internet banking, account-to-wallet, instant interbank transfer or GhQR services no dey available, dem say customers fit use ATMs, USSD, GhanaPay, branch counters, or authorised agents.
Bank of Ghana add say dem go review di measures as di situation dey develop, and any change wey happun dem go communicate am to the public.
Di bank also direct banks make dem keep customers informed about affected services and expected restoration timelines, say some institutions blame di disruptions on system maintenance while odas link am to technical issues.
Di central bank urge di public make dem remain calm and vigilant, warn say make customers no share dia PINs, passwords or one-time passwords (OTPs) wit anybodi.
Customers lament as Banks for Ghana experience downtime

Wia dis foto come from, Getty Images
Customers for many banks for Ghana dey frustrated for many hours from Friday 27 November as dia digital banking shutdown.
Many subscribers receive messages and prompts from dia banks to confam say dia digital system dey experience downtime.
Dis happun across many banks for di West African kontri, wey make customers dey vex.
Di banks no explain wetin cause di shutdown, wey sabi pipo no dey rule am system attack.
Banks like Access Bank, GCB Bank, First Atlantic, Fidelity Bank, Stanbic Bank among odas don dey affected.

Wia dis foto come from, MALISE
One Access Bank customer tell BBC News Pidgin say im no fit send or receive money for many hours, and dat don scata im weekend plans.
"I try to do transaction on top my bank app, but e no dey work. Di app dey show me zero balance for my account. I bin first panic, but di bank later restrict access to di account," Malise Omoloye tok.
E explain say, "If you wan use di app, dem go tok say e dey restricted to staff accounts only, dem later block evribody wey bin dey try to log into di account."
Malise tell BBC News Pidgin say di bank don send am message now.
"Now di bank tok say dem get downtime for dia digital system and dem dey work to fix am; now we no fit log into di app, di USSD option too no dey work, I bin try to check my balance wit di USSD, but e dey show error."
Anoda customer wey dey use GCB Bank also explain to BBC News Pidgin wetin happun when im try to do online transaction.
"GCB Bank and Access Bank no send me alert, I realise say wahala dey wen I bin dey try to do one transaction for di Access Bank app and e no work," Denis Pwaberi Wedam explain.
E add say "I bin later see di reports online say dem get problem, bifor I bin tink say na network wahala for my side."
Apart from individuals wey suffer well well, oda pipo wey get multiple bank accounts for dia business also bin complain.
One media personality and businessman Kojo Akoto Boateng write on top im social media page say transaction for all im four banks no dey work.
"I don receive message from di banks I dey do business wit, but none of dem bin give any proper reason why we no fit do transaction for di digital platforms."
Kojo Akoto Boateng add say "di regulators gatz explain to us wetin dey happun."
One entrepreneur Victor Elorm Morgah bin ask "all di banking apps dey under cyber-attack? How come all of dem dey under maintenance?"
Wetin di banks tell dia clients

Wia dis foto come from, Ernest Ankomah/Bloomberg via Getty Images
Access Bank – Kindly note say our digital platforms remain unavailable sake of ongoing system maintenance. We dey work to restore dis services as quickly as possible, for di meantime, you fit use our ATMs and your card for transaction. We apologise for di wahala.
GCB Bank – Sake of system maintenance, our digital banking services dey temporarily unavailable. Make you use our ATMs across di kontri as we work to restore di services.
First Atlantic Bank – We dey experience intermittent disruption for some of our digital channels. Our card services, ATMs dey active for your payment and cash needs.
Fidelity Bank – We dey inform you say we dey experience intermittent service wahala for some of our digital channels. Our card services, ATMs, and agent points remain available to assist wit your payment or cash needs.
Oda banks send similar message to dia clients; e no dey clear how soon dem go fix dis wahala.
Di Bank of Ghana no comment for dis mata, except to announce say di new Ghana cedi heritage notes wey dem bin launch for November, go dey in circulation for 1 December 2026.




















